BET Awards 2021: Burna boy, Wizkid and Diamond Platnumz dey nomination list – See how to watch
BET Awards 2021: Burna boy, Wizkid and Diamond Platnumz dey nomination list – See how to watch
Two Nigerian artistes, Burna Boy and Wizkid, dey among di nominees for Best International Act category for di Black Entertainment Television (BET) Awards 2021 wey go shelle on Sunday.
Di show wey go happun for Microsoft Theatre inside Downtown Los Angeles, go be di first major live, in-person awards show since di pandemic begin worry.
Dem go film am live with physical audience members and American actress, Taraji P. Henson na im go host di event.
Many artistes like Migos, DJ Khaled, Jasmine Sullivan, Lil Baby, Lil Durk, Tyler the Creator and Kirk Franklin. H.E.R. and DaBaby dey among odas wey go perform.
Swizz Beatz go do tribute to DMX, wey die for April for di age of 50.
BET Awards na American award show wey di Black Entertainment Television network establish for 2001 to celebrate African Americans in music, acting, sports, and oda fields of entertainment.
2021 BET Award Date, Time and wia to watch
Di BET 2021 Awards go start on Sunday, June 27 around 8PM EDT/ 7PM CT sharp with pre-show wey go kick off around 7PM EDT/4PM CT.
Pipo fit watch live stream of di awards for dia house through dia cable subscription or dem fit also enta Youtube to watch am live.
Who be di Nominees dis year?
Dis year year most-nominated honorees na; Rapper Megan Thee Stallion (wey dey up for almost every major category she fit be) and DaBaby. Both of dem get seven nominations each.
Odas wey follow dem for back closely na Cardi B and Drake, wey get five nominations.
Also, two Nigerian artistes Burna Boy and Wizkid dey among di nominees for Best International Act category.
Burna Boy win di Best International Act category for di 2019 and 2020 BET Awards. While Wizkid win am for 2012, wen di category get two divisions for Africa and UK.
For 2020, Wizkid also win di BET HER Award for ‘Brown Skin Girl.’
Dis na how di nominees list be dis year;
ALBUM OF THE YEAR
After Hours – The Weeknd
Blame it on Baby – DaBaby
Good News – Megan Thee Stallion
Heaux Tales – Jazmine Sullivan
King’s Disease – Nas
Ungodly Hour – Chloe x Halle
BEST COLLABORATION
“WAP” – Cardi B feat. Megan Thee Stallion
“Rockstar” – DaBaby feat. Roddy Ricch
“Popstar” – DJ Khaled feat. Drake
“Whats Poppin (Remix)” – Jack Harlow feat. DaBaby, Tory Lanez & Lil Wayne
“Cry Baby” – Megan Thee Stallion feat. DaBaby
“For the Night” – Pop Smoke feat. Lil Baby & DaBaby
BEST FEMALE R&B / POP ARTIST
Beyoncé
H.E.R.
Jazmine Sullivan
Jhené Aiko
Summer Walker
SZA
BEST MALE R&B / POP ARTIST
6LACK
Anderson .Paak
Chris Brown
Giveon
Tank
The Weeknd
BEST NEW ARTIST
Coi Leray
Flo Milli
Giveon
Jack Harlow
Latto
Pooh Shiesty
BEST GROUP
21 Savage & Metro Boomin
Chloe x Halle
Chris Brown & Young Thug
City Girls
Migos
Silk Sonic
BEST FEMALE HIP HOP ARTIST
Cardi B
Coi Leray
Doja Cat
Megan Thee Stallion
Latto
Saweetie
BEST MALE HIP HOP ARTIST
DaBaby
Drake
J. Cole
Jack Harlow
Lil Baby
Pop Smoke
BOBBY JONES BEST GOSPEL/INSPIRATIONAL AWARD
“In Jesus Name” – Bebe Winans
“Never Lost” – Cece Winans
“Hold Us Together” – H.E.R.
“Strong God” – Kirk Franklin
“Thank You for It All” – Marvin Sapp
“Touch From You” – Tamela Mann
BET HER AWARD
“So Done” – Alicia Keys Ft. Khalid
“Baby Mama” – Brandy feat. Chance the Rapper
“Anti Queen” – Bri Steves
“Baby Girl” – Chloe x Halle
“Rooted” – Ciara feat. Ester Dean
“Good Days” – SZA
BEST INTERNATIONAL ACT
Aya Nakamura (France)
Burna Boy (Nigeria)
Diamond Platnumz (Tanzania)
Emicida (Brazil)
Headie One (UK)
Wizkid (Nigeria)
Young T & Bugsey (UK)
Youssoupha (France)
VIEWER’S CHOICE AWARD
“WAP” – Cardi B feat. Megan Thee Stallion
“Go Crazy” – Chris Brown & Young Thug
“Rockstar” – DaBaby feat. Roddy Ricch
“Popstar” – DJ Khaled feat. Drake
“Laugh Now Cry Later” – Drake feat. Lil Durk
“The Bigger Picture” – Lil Baby
“Savage (Remix)” – Megan Thee Stallion feat. Beyoncé
“Leave the Door Open” – Silk Sonic
VIDEO OF THE YEAR
“Up” – Cardi B
“WAP” – Cardi B feat. Megan Thee Stallion
“Do It” – Chloe x Halle
“Go Crazy” – Chris Brown & Young Thug
“Laugh Now Cry Later” – Drake feat. Lil Durk
“Leave the Door Open” – Silk Sonic
VIDEO DIRECTOR OF THE YEAR
Benny Boom
Bruno Mars and Florent Déchard
Cole Bennett
Colin Tilley
Dave Meyers
Hype Williams
BEST MOVIE
Coming 2 America
Judas and the Black Messiah
Ma Rainey’s Black Bottom
One Night in Miami…
Soul
The United States vs. Billie Holiday
BEST ACTRESS
Andra Day
Angela Bassett
Issa Rae
Jurnee Smollett
Viola Davis
Zendaya
BEST ACTOR
Aldis Hodge
Chadwick Boseman
Damson Idris
Daniel Kaluuya
Eddie Murphy
Lakeith Stanfield
YOUNGSTARS AWARD
Alex R. Hibbert
Ethan Hutchison
Lonnie Chavis
Marsai Martin
Michael Epps
Storm Reid
SPORTSWOMAN OF THE YEAR AWARD
A’ja Wilson
Candace Parker
Claressa Shields
Naomi Osaka
Serena Williams
Skylar Diggins-Smith
SPORTSMAN OF THE YEAR AWARD
Kyrie Irving
LeBron James
Patrick Mahomes
Russell Westbrook
Russell Wilson
Stephen Curry
About dis year BET Award
Connie Orlando, BET Executive Vice President of Specials, Music Programming & Music Strategy tok for one statement say dem dey look forward to celebrate black women during dis year show.
“Di BET Awards na di ultimate celebration of Black culture, and we dey look forward to spotlighting and celebrating Black women during dis year show
“Recognizing dem for everything wey dem don accomplish and applaud dem for what to come



[Video] Flavour – Levels
Watch Here